Friday, 3 July 2015

[Gist]: Yemi Alade Dey Big Wahala As Her Ghanaian Fans Dey Yab Her Because of Stonebwoy BET Awards Win

Our own Naija singer wey be BET Awards nominee, Yemi Alade don go enter gbege as Ghanaian pipu dey attack her for instagram sake of wetin she yarn about di win wey Stonebwoy win for di Best International Act, Africa.

Di Ghanaian pipu wey no get joy wey dey vex for her well well, just dey bomb her instagram page anyhow with plenti badbelle messages because of wetin she yarn about Stonebwoy wey be Ghana person.

Yemi Alade wey no happy about di person wey win di award, start all di palava wey she say di pipu wey organize di award no try as dem carry di Best International Act, Africa give Ghanaian dancehall artiste, Stonebwoy.

According to wetin she yarn, she say di organizer suppose reason:
"credibility over paddy paddy?"
She still vex for BET say dem no dey give African artistes level and respect atol atol.

But her Ghanaian fans no gree as dem dey yab her well well for instagram since. (see di screengrabs dem for down).

No comments:

Post a Comment